fbpx
May 18, 2024

Careca dey compare Osimhen to Pele

careca-compare-osimhen-pele

Napoli legend Careca recently compare Partenopei striker Victor Osimhen to Pele, hin praising di goal wey hin score against Roma recently.

Osimhen na one of di most potent goal-scorers for di top five European leagues this season and hin don form shocking partnership with Khvicha Kvaratskhelia. Hin playing di key role because hin keep Napoli for di top of di Serie A table.

Di Nigerian fit cement unique legacy for Naples if hin carry di club go di first Scudetto since di Diego Maradona days. And one of Maradona former Napoli teammates, Brazilian legend Careca, for interview with Calciomercato, don compare Osimhen to hin late countryman Pele.

Careca yarn say Napoli dey strong, dem dey play well and dem dey united.

According to am, hin tok say hin follow Spalletti tok, and di guy make wonderful impression on am. Also, hin mention say di same goes to di players. Na for other hin mention Osimhen.

Hin yarn say Osimhen dey very strong and he go become even stronger because he wan improve and hin still get something to work on.

“He is unstoppable and he has an impressive physical superpower. In the goal scored against Roma, I saw something similar to Pelé. He dominated the ball, dominated the defender, and smashed the goal. In that goal, there is everything, technique, malice, and power.” Na wetin Careca yarn be thart.

You fit go read di full tori…READ MORE