fbpx
May 7, 2024

Casemiro don list five high quality players for Man Utd

casemiro-don-list-quality-players-for-man-utd

Manchester United midfielder Casemiro don list five high quality players of his teammates wey dey Man Utd for praise.

Dis update dey come after hin win hin first trophy (Carabao Cup) under di coach of di club, Erik ten Hag last weekend.

Speaking on United Review, di Brazilian football player list Lisandro Martinez, Christian Eriksen, Raphael Varane, Bruno Fernandes and Fred as crucial causes for di success of di club.

As Casemiro list di players for Man Utd, hin call di players high-quality footballers and world-class players.

FOR MORE NEWS: Musa, Ebi snub Osimhen, Oshoala for FIFA awards

According to am, every team get hin own way of playing. And na true here say hin get greater role for di attack

However, hin yarn say e dey impossible for one person am on hin own. Na di quality of hin teammates follow help according to am.

Hin tok about Licha (Lisandro Martinez) and Varane – He yarn say dem be high-quality players.

Also, hin yarn say“Christian, wey hin play alongside for a long time, na another exceptional player. Fredinho (Fred) na another excellent player, then Bruno, wey dey play forward, na world-class player.

You fit go read di full tori…READ MORE