fbpx
April 28, 2024

CBN dey under pressure to shift Jan 31 deadline

cbn-dey-under-pressure-to-shift-jan-31-deadline
CBN dey under pressure to shift Jan 31 deadline. Banks and Customers still dey tell CBN make dem shift di Jan 31 deadline of old naira note.
Dem bin don tok say from January 31, di old naira note no go be legal tender again.
But as e be now, customers and bankers dey tok say dem need to extend di date.
From how dem take plan am, by now old naira notes no suppose dey pipo hand again. But di wahala be say di new naira note scarce, na wetin make most bank still dey dispense old notes to their customers. Dem dem expect say by January 31 di old notes go dey out of circulation.

Some reports show say different stakeholders dey put pressure for  apex bank so that dem go extend di deadline. This na to make sure say di new notes circulate well and all di old note go comot.

One better source wey wey dey drop this information yarn say di bank managing directors no fit make di call for di deadline extension openly because di decision on di redesign of naira follow get approval.

Now wey e be like say CBN dey under pressure to shift Jan 31 deadline, shey dem go extend di date?

You go like read di full tori…READ MORE