fbpx
May 18, 2024

Charly Boy don follow React to Hakimi, Ex-Wife’s Divorce Saga

charly-boy-react-to-hakimi-saga

Charles Oputa, aka Charly Boy, a veteran Nigerian singer, don react to di Saga wey claim say Achraf Hakimi estranged wife, Hiba Abouk, demand more than half of hin fortune during dia divorce proceedings but dem tell her say di PSG star no get assets because hin don transfer all hin fortune go hin mama name.

On hin verified Twitter page on Friday, Charly Boy hail di Moroccan international as hin outsmart hin ex-wife.

According to di Nwata Miss singer, Hakimi ex-wife bin wan try game di system by filing for divorce and demanding half of hin assets, but di footballer outsmart her.

FOR MORE NEWS: Buhari don meet Nigerian officials for Saudi, hin receive update on elections

He wrote: “Cunny man die, cunny man bury am.

“Dis Achraf Hakimi the football has dribbled his wife wey file for divorce and demanded half of his property. Hmm, some women sha.

According to Charly Boy, di woman weak when court tell her say her ‘Millionaire’ husband no get anything.

Everything wey hin get dey for hin mama name.”

Also, hin mock “gold diggers,” and hi advise women make dem work hard for dia own money.

You fit go read di tori as Charly Boy react to Hakimi saga…READ MORE