fbpx
May 18, 2024

Sex Scandal: Charly Boy don warn Apostle Suleman, hin reveal scary dream too

Charly-Boy-don-warn-Apostle-Suleman

Veteran Nigerian entertainer and activist, Charles Chukwuemeka Oputa, wey dey known as Charly Boy or Area Fada, don warn di general overseer of Omega Fire Ministries International, Apostle Johnson Suleman.

You fit remember say Suleman don dey make headlines over hin allege sexcapades with Nollywood actress Halima Abubakar and other celebrities.

Halima bin don open up on how di cleric allegedly sleep with her even when she bin dey bleed and how she take do three abortions for am.

Charly Boy react to this matter on Tuesday for twitter with hin Twitter handle. Hin yarn say e no be news again say plenty pastors for Nigeria dey engage in fraudulent activities.

Hin yarn say, no be say hin like to yab pastors’, but hin know say plenty Nigerian pastors na wayo and scammers.

Di case with Apostle Suleman dey different.

Charly Boy warn Apostle Johnson Suleman say make hin dey careful. As hin tok that one finish, hin yarn say he dream as one woman attack Apostle Suleman lat night. For di dream, di woman cut Apostle Suleman manhood comot.

Hin even advise di Apostle say make hin go find another business idea. This na as e be say na to ball women di Apostle sabi.

You fit go read di full tori…READ MORE