fbpx
May 2, 2024

Chichi bag two endorsement deal as she celebrate her 23rd birthday

Chichi-bag-two-endorsement-deal

Chichi wey be Reality TV star and dancer don bag endorsement deal with one auto dealing brand, Unique Motors.

This controversial public figure enter her instagram page announce her new accomplishment.

E no end there, she announce say na 2 major brands sign her on her birthday, one of them na hin be Unique motors.

FOR MORE NEWS: Phyno, sickle cell carrier – Shey na true?

As she make this announcement, she tok say God dey faithful her and na hin help her run am. She add say she get plenty things to thank God for and as she start di year with testimony, na so e go be throughout di year.

On top all this good new wey she share with her fan for Instagram, she announce di brand new car wey she buy for herself on her birthday.

Chichi bag two endorsement deal, this update for di saga and trending topic about her age.

You go like go read di full tori…READ MORE