fbpx
May 2, 2024

Phyna yarn say she neva do abortion before.

Phyna-yarn-say-she-neva-do-abortion-before-

After Phyna come out, confess say she comot two belle before age 25, she don change mouth for di matter now. Big Brother Naija season 7 winner, Ijeoma Josephina Otabor, don change mouth on top abortion matter o. Phyna yarn say she neva do abortion before.

You go remember say Phyna bin don open up say she do two abortions. She send this reply to Twitter troll wey accuse her of di act.

Punch Newspaper follow claim say dem interview Phyna, and she tok how she take comot 2 belle. She tok di reason why she do am too.

Di matter now be say, for inside audio notes wey controversial Nollywood actor, Uche Maduagwu share, Phyna don change mouth.

FOR MORE NEWS: Phyna bbnaija confess why she komot two belle before age 25

That audio note contain di conversation wey di actor get with Phyna concerning that matter.

Phyna don confam am for di audio note say, she just tok am make di mind of those twitter troll sweet. And she admit so that she go fit fire back wella.

E just be like when person tok say 1+1 na 1, whereas na 2 for reality.

Phyna yarn say anytime wey person drop bad comment for her, maybe she and di person get matter wey dem neva settle, she go first accepts di thing wey di person tok before she show dem her color.

Phyna yarn say she neva do abortion before.

Sharing the audio notes, Uche Maduagwu wrote:

You go like read di full tori…READ MORE