fbpx
May 9, 2024

China don call for di safety of Gabon President Bongo

china-call-for-bongo-safety

China on Wednesday call “all sides” for Gabon make dem guarantee di safety of President Ali Bongo Ondimba after a group of military officers yarn say dem wan end di current regime for di West African nation.

Foreign ministry spokesman Wang Wenbin, call on all sides for Gabon make dem do wetin dem need to do with di basic interests of di country and di people.

 

FOR MORE NEWS: Gunfire for Gabon as soldiers seize power, cancel election result

 

Also, as di Foreign ministry spokesman wey dey China call for Bongo safety, hin tok say make dem settle di matter wey dey ground through discussion, (and) restore normal order as soon as possible. In addition, hin call on parties say make dem “guarantee di personal safety of President Bongo, and make dem uphold national peace and stability”.

You fit go read di tori …READ MORE