fbpx
May 8, 2024

Presidential matter: Tinubu, Atiku, Obi, APM don begin battle for Supreme Court

presidential-matter-tinubu-atiku-obi-apm-don-begin-battle-for-supreme-court

LAGOS — President Bola Tinubu and hin antagonists-Alhaji Atiku Abubakar, Mr Peter Obi and di Allied Peoples Movement, APM, go resume di battle for presidency, today, for di Supreme Court as Tinubu aides and di main opposition Peoples Democratic Party, PDP, expect favourable ruling for di apex court.

Na on Thursday last week na hin di Supreme Court communicate di hearing date through notice wey dem send to all di parties

Apart from say dem fault di verdict of Presidential Election Petition Court, PEPC, wey confirm Tinubu election, Atiku bin follow file for permission to tender copy of Tinubu academic records wey Chicago State University, CSU, USA, release. Atiku yarn say di record show say Tinubu submit CSU certificate wey dem forge to di Independent National Electoral Commission, INEC.

Also, di former vice president dey find way to get Washington, D.C. court to order FBI make dem release documents on President Tinubu’s $460,000 forfeiture case.

 

FOR MORE NEWS: Students go undertake drug test before admission — UniAbuja

 

Yesterday, di PDP yarn say dem get confident say dia appeal go succeed for di Supreme Court.
Inside statement by di National Publicity Secretary, Debo Ologunagba, di PDP yarn say dia confidence dey on di provisions of di Constitution and relevant sections of di Electoral Act 2022 (As amended).

Meanwhile, Mr Bayo Onanugta, Special Adviser on Information and Strategy to President Tinubu, don accuse di followers of Atiku and Obi say dem dey try rush di Washington, D.C. court make dem change di order wey dem bin give FBI to release documents on President Tinubu’s forfeiture case of 1993.

Di party want make di apex court declare say di return of Tinubu by INEC as President-elect dey null, void, and of no legal effect whatsoever.

Also, APM dey pray make di Supreme Court nullify and void all votes wey APC score for di Presidential election, as well as to make order, wey go direct INEC to return di second-highest score for di election as winner of di presidential contest.

Meantime, President Tinubu, APC and INEC don ask di apex court since say make dem dismiss di appeals because e no get merit.

In addition, President Tinubu follow tell di court say make dem reject application wey Atiku filed for permission to tender a copy of hin certificate wey Chicago State University for USA release.

You fit go read di tori of dis presidency battle for court…READ MORE