fbpx
May 4, 2024

FG must address the increase for cooking gas price —NALPGAM

Concern-over-di-rising-price-of-gas

National President of di Nigerian Association of Liquefied Petroleum Gas Marketers, NALPGAM, Mr. Abideen Olatunbosun, yesterday, express hin concern over di rising price of gas. Hin add say if FG no address di matter, gas fit become commodity wey only pipo wey get plenty money go fit buy.

However, di association, don advise di Federal Government say make dem make sure say di price of cooking gas for di kontri dey stable.

Olatunbosun express hin concern over di rising price of gas during di 36th Annual General Meeting, AGM of di association, wey hold for Ibadan.

Also, hin tok say di continuous increase for price of gas, stands as big challenge to LPG marketers. Di increase for di price of gas na worry to plenty pipo.

 

FOR MORE NEWS: “Who be di papa of your pikin?” – Kemi Olunloyo threaten Mohbad wife with DNA report

 

Hin tok say as Kontri wey we be, we need to dey use gas well, because if pipo dey use gas well, that one go save our forest and e go improve di quality of our lifestyle and di economy sef go grow.

Also another person wey tok na di Executive Director of Distribution Systems, Storage and Retailing Infrastructure of di Nigerian Midstream And Downstream Petroleum Regulatory Authority, NMDPRA, Mr Ogbugo Ukoha. Hin yarn say di recent deregulation policy go result in a reflective petroleum products pricing.

Ukoha still tok say di current data don show say di domestic gas supply don overtake di import supply.

You fit go read di tori…READ MORE