fbpx
April 26, 2024

Covenant University don win best private university award

0

OUT of 111 private universities for Nigeria, Covenant University don emerge winner for di Nigeria Prestige Education Award as di university collect di best private university Award.

Di Nigeria Prestige Education Awards.event wen bi sele for weekend,for di purpose of honoring outstanding Primary, Secondary schools and Tertiary institutions all over Nigeria.

U FIT ALSO READ Pay ASUU money Reduce lawmakers’ salaries by 50 percent – Ndume tell FG

Covenant University let everybody know say na dem bi dia papa inside di jungle as dey emerge as di Best Private University of di year 2022.

Di Vice-chancellor, Professor Abiodun Adebayo highly represented bi di Dean of Student Affairs, Professor David Imhonopi, Key members of staff and Student Council Executives.

Di Organizer of di event, Mr.M.A.Obiola,wen hin dey give hin speech yarn say dis prestigious awards and recognitions can only bi issued to di most outstanding private schools for Nigeria.

When di Vice-Chancellor, ProfessorAbiodun H. Adebayo, and hin team dey collect di award hin tok say hin return all di glory to Almighty God for everything.

Di Dean, for di event,tok say, “E go make sense say all dis praise wen dem dey give di school no bi human power oo but na God do am for dem.

Hin con back up him speech with one verse of di bible wen say “No man can receive anything from the Lord except it is given to him”.

Prof still appreciats di Board of Regents led bi di Chancellor, Dr. David O. Oyedepo, hin tok say di man don try for di school well well say make everybody appreciate di oga for ram.

Hin still add dis one join say ”Covenant University wen una see so,na God-found am, na God dey provide money for ram and na di same God still dey run am for dem.

To read di full tori CLICKHERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *