fbpx
April 23, 2024

ASUU to begin anoda strike, as Adamu tackle lecturers

0

Di Federal Government and di Academic Staff Union of Universities (ASUU) don dey prepare for another strike as di Minister of Education, Adamu Adamu, don insist say di government no go pay full salaries to those lecturers upon say dem dey do nationwide protest.

ASUU since on Monday don begin nationwide protest across di countri to demand for dia full pay salary after di Federal Government don fail to pay dem for di eight-month wen lecturers dey on strike.

U FIT ALSO READ ASUU Strike: E dey pain me as tertiary education system dey stop anyhow – Buhari 

Adamu,yarn tori pipol for Abuja on Wednesday say, if dem like make dem protest nothing concern am only thing wen him know bi say you no fit collect money for work wen you no do.

Di minister tok concerning wetin President of ASUU, Professor Emmanuel Osodoke yarn, hin tok say FG wan use style style turn university lecturers to casual workers.

Adamu tok say na big lie,say nobody fit try am and him no dey aware say lecturers wan go on a day protest against FG

President, of ASUU, Osodeke, on Wednesday tok say Nigerian politicians don dey plan to privatise federal universities across di countri through public- private partnership.

Hin tok say since FG don decide to stand on di policy of no work no pay,so dem self don readi to give dem back as e dey hot.

To read di full tori CLICKHERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *