fbpx
May 9, 2024

NANS go shut down Akure over death of FUTA 500-level student

nans-lament-over-death-of-500-level-student

Di National Association of Nigerian Students NANS dey lament over di death of one 500-level student of di Federal University of Technology Akure (FUTA), Akeredolu Clinton Ayomide. Also, dem dey call on di Southwest (Zone D) and Ondo State Joint Campus Committee (JCC) to organise a mass action against di university over di incident on Tuesday, August 29, 2023.

Also, di student body demand for di resignation or suspension of di Healthcare Director.

In addition to dat, dem make call say make di management of FUTA properly and effectively equip di University health centre in di next 72 hours to prevent further occurrence.

 

FOR MORE NEWS: “I almost commit suicide” — Iyanya don open up

 

These demands dey contained inside statement by NANS Vice President (External Affairs), Babatunde Afeez Akinteye.

Akinteye yarn say di demise of dia dear student reach dem as shock. Also, hin tok say words no fit express how dem feel.

Also, di student leader lament about di negligence of di institution in handling di matter. Di student leader yarn say di association no fit just stand life dat dey watch as ugly event like dis continue for di institutions without putting in place measures wey go put an end to such unfortunate occurrence.

You fit go read di full tori see as NANS dey lament over di death of 500-level student…READ MORE