fbpx
May 3, 2024

Na grace I survive 2020/2021”- Annie Idibia narrate her years of marital crisis

annie-reflect-on-marriage-crisis

Annie Idibia, wey be Nollywood actress, dey reflect on her marriage crisis wey public bin don chook mouth put, and how e nearly make dem divorce.

Remember how, in 2021, Annie Idibia openly call out her husband, and she accuse am say  hin dey have affair with hin second baby mama, Pero Adeniyi, and dat matter bin nearly make dia marriage fail?

Now wey she dey think about di matter, Annie yarn say she no know how she take overcome di scandal.

She attribute am to Grace, and she note how di Universe always dey on her side.

“It’s been just GRACE!!! The universe always working in my favor”.

 

FOR MORE NEWS: Trailer Crush 8 To Death For Abuja

 

For inside di voice-over, wey follow di video wey she share online, she yarn say she dey very much aware of wetin pipo tok about her, but over the years, she don grow to ignore them.

“I am very much aware of what people say about me, every single thing. But the difference between now and three years ago, is I obviously don’t care anymore”.

Annie bin no only drag her husband and hin baby mama, but she follow accuse hin family say dem no love or care for her since dia marriage.

Also, she yarn say 2baba spend nights under di same roof of di children mama, Pero Adeniyi.

You fit go read di tori as Annie reflect on her marriage crisis…READ MORE