fbpx
May 5, 2024

Reactions as Davido tok say hin dey charge $600,000 for one show

davido-reveal-hin-charge-to-perform

Many pipo dey talk about Afrobeat singer David Adeleke a.k.a. Davido after hin reveal how much hin dey charge to perform for one show.

Inside one recent interview, di DMW music boss, Davido reveal di amount wey hin dey charge to perform for one event and how many concerts hin dey attend in a month.

Hin tok for inside di viral video say hin dey charges 600,000 dollars (550,000 million naira) for each performance  wey person invite am to.

Also, hin reveal say, because of di expensive price wey hin dey charge for one event, hin limit di number of shows wey hin fit attends in a month to at least four.

Davido underline say hin dey normally get fewer shows to attend during di month because only a small number of individuals fit afford hin services.

He rounded up di amount wey hin dey earn in a month between $2million to $3million

“I mean now shows are $600,000. Now it is less. Actually a month $2 million, $3 million”.

 

FOR MORE NEWS: Burna Boy drop hint say hin go retire from music

 

Reactions

Since dat time, di video don stir reactions. Also plenty pipo dey wonder how much hin rivals, Wizkid and Burna Boy dey charge for one show.

One I am Bull write, “If you charge $600k that means Odogwu Burna will charge x4. OluwaBurna is on a different level

One Ezeqwesin write, “He’s worked hard for it and he deserves it. The likes of Jay Z, Drake, and Beyonce charge in millions

One DJ Rat Official write, “No wonder why young Du wan die there

You fit go read di tori…READ MORE