fbpx
May 4, 2024

Poco Lee gift hin mama multi-million naira house

poco-lee-gift-hin-mama-house

Famous dancer and music composer, Poco Lee don put smile on di face of hin mama as hin gift her house wey worth millions of naira.

Di singer take to hin Instagram page on Monday to share di announcement of di token of appreciation to hin mama.

Also, as Poco Lee gift hin mama house, hin call hin mama di latest landlady for Lagos, Pocolee share stunning photo with hin mama on her birthday.

 

FOR MORE NEWS:Β Reactions as Davido tok say hin dey charge $600,000 for one show

 

On top dat one, hin add photo of her during di days wey she dey struggle dey sell roasted yam for road

β€œLagos latest landlady, Thank you lord πŸ™πŸ»πŸ™πŸ»,” Na wetin hin write be dat.

Fans and well-wishers flood di comment section to congratulate Poco Lee and hin mama for di latest house acquisition.

You fit go read di tori….READ MORE