fbpx
May 4, 2024

“I don’t feel like they have left me” – Davido don tok on losing people wey dey close to am.

davido-don-tok-on-losing-people-and-hin-dedicate-di-album-timeless-to-dem-

Davido a Nigerian music legend during interview for Beat FM don tok on losing pipo wey dey close to am and hin dedicate one song for hin album, Timeless to dem.

As hin dey tok for interview for Beat FM, Davido, wey release hin albumTimeless today, March 31 tok about losing pipo wey dey close to am.

You go remember say di singer lose hin first son, Ifeanyi Adeleke on di 31st of October, 2023. When dem ask am about di track wey dey hin album, Legends Can Never Die, LCND, Davido yarn say e dey dedicate di album Timeless to pipo wey hin lose.

FOR MORE NEWS: Pete Edochie dey mourn hin grandson, Kambilichukwu

From losing hin mama at 10 to losing hin best friend, hin bodyguard, and then hin son. Di singer share say although dem don go but he still dey feel dia presence around am. According to am, na wetin bring di song, Legends Can Never Die.

Also, hin yarn say di song na for everybody out there wey don lose one or two close pipo for dia life. Davido still share say di song na di oldest on top di album, and hin record am 2 years ago for Los Angeles.

You fit go read di tori…READ MORE