fbpx
May 18, 2024

I smart pass pipo wey go school – Portable dey boast

portable-dey-boast

Nigerian singer, Habeeb Okikiola, wey dey known as Portable, dey boast say hin smarter pass most pipo wey go school.

Di ‘Zazoo’ crooner, as hin dey reflecting on hin life, yarn say he don learn more inside streets than for di four walls of classroom.

Portable wey dey boast tok dis one on top hin social media handles on Thursday, amidst di matter wey hin get with di Nigeria Police.

Inside di Instagram post, di controversial singer write, “Zazuu I have learned more in the streets than in any classroom. I’m still smarter than you in the Zoo my future is in God’s hands. Ika of Africa Akoi Grace. Dr Zeh Nation many many inspiration.”

FOR MORE NEWS: Viral video: Portable get 75-hour to report self to police

Remember say Portable collect 72-hour ultimatum from di Ogun State Police Command to report himself to di nearest police station after dem capture am inside viral video dey resist arrest by operatives of di force.

However, inside video shared on hin Tiktok page, di singer explain say di man wey bring di police to arrest am na hin ex-worker and hin bin dey into Internet fraud against hin advice.

He claim say he discipline di ex-staff after he no gree change hin ways and he sack am.

Also, hin maintain say di thing wey happen between him and di complainant na none of di police business, and hin insist say hin get di right to beat hin worker.

Di 72-hour ultimatum wey Police give Portable on Wednesday go expire on Friday [today].

You fit go read di tori…READ MORE