fbpx
March 19, 2024

Pete Edochie dey mourn hin grandson, Kambilichukwu

pete-edochie-mourn-hin-grandson

Veteran actor, Pete Edochie dey mourn hin grandson, Kambilichukwu wey die on Thursday, just 2 months after hin 16th birthday.

Di actor confirm di news to Vanguard when he share say Yul call am for phone on Wednesday, inform am say Kambilichukwu fall for ground as hin dey play football with hin schoolmates and hin develop seizure.

According to am, dem rush di deceased go di Mother and Child Hospital, Lagos, where hin die hours later.

FOR MORE NEWS: Yul Edochie don report hin son death to police, investigation don start

Di legendary actor Pete Edochie wey dey mourn hin grandson yarn say him and hin family start to dey pray for di pikin immediately after di call.

Pete yarn say Kambilinachukwu na very quiet, brilliant and talented pikin. Also, hin no be pikin wey somebody fit ride easily. Hin no dey vex no matter the situation,”

In addition, Pete yarn say di pikin fit change hi composure, but hin na very unusual person in so many respects.

“He was so accomplished. I always tell my son that I don’t like people excelling like this in any thing they are involved in. Experience has taught me that such people don’t last long.”

You fit go read di tori…READ MORE