fbpx
May 4, 2024

Davido congratulate BBNaija All Stars winner, Ilebaye

Davido express love for Ilebaye

Davido, wey be well-known Nigerian Afrobeat musician, don publicly express hin love for Big Brother Naija All-Stars winner Ilebaye Odiniya’s inspiring story.

Di reality TV show main prize, worth na N120 million, and na Ilebaye, wey be 22-year-old model from Kogi State na hin win am for, di climax on Sunday night.

Plenty pipo surprise say she win dis one as dem bin eliminate her before during her first debut for di “Level Up” season 2022,

She bin started di show as person wey no go gt chance to win at all for di All-Stars season.

 

FOR MORE NEWS: Tonto Dikeh react as Sam Larry enter Nigeria

 

Ilebaye overtake her nearest rival, Mercy Eke, wey receive 23.48% of di vote, to win with an beta 30.8% of di total votes.

Na dis success tori make Davido express hin love for Ilebaye, hin enter hin social media platform to share hin admiration.

Davido write;

“Ilebaye… I love a success story!”

To answer wetin Dvido tok, Ilebaye express her gratitude for di comments section,

“Thank you OBO,” na wetin Ilebaye write be dat.

You fit go read di tori…READ MORE