fbpx
May 4, 2024

Tonto Dikeh react as Sam Larry enter Nigeria

tonto-dikeh-reacts-as-sam-larry-enter-nigeria

Nollywood actress Tonto Dikeh don react to di arrival of di assistant of Naira Marley, Sam Larry for Nigeria after Mohbad death.

Tonto Dikeh, enter her page claim say di popular socialite Samson Balogun Olamilekan Eletu, aka Sam Larry, bin try to sneak enter di kontri but police arrest am for di Lagos’ Murtala Muhammed International Airport.

E don tey wey pipo dey call for Sam Larry’s arrest because hin get connection with rapper Ilerioluwa Oladimeji Aloba, aka Mohbad untimely death. Dis na after pipo watch video of how hin raid Mohbad music video shoot and how hin threaten di singer with armed men.

 

FOR MORE NEWS: WHO don release $16m to tackle cholera

 

Also, Tonto wey react to Sam Larry arrival share five-second video of Sam Larry as hin reach airport on Thursday night, she write say “Sam Larry wan sneak enter Nigeria.” This is happening right now. Sam Larry, welcome back.” Na wetin she tok be dat.

Meanwhile, di Lagos State Police Command don confirm Sam Larry detention.

SP Benjamin Hundeyin, di command spokesperson, tok am via X say Sam Larry dey “help” dem with di ongoing investigation of Mohbad death.

You fit go read di tori….READ MORE