fbpx
April 20, 2024

Dem get agenda wey dem dey hide – Mixed reactions don follow CBN new naira notes

0
CBN-naira-notes-redesign

Nigerians don share different opinions about di new banknotes wey President Muhammadu Buhari administration just release.

Di Central Bank of Nigeria, CBN, on Wednesday announced di entry of di new notes for di country financial space.

Di CBN boss, as hin dey explain di features of di redesigned notes, hin tell di State House Correspondents say e dey in line with global best practices, and e dey  mandatory for dem to redesign and re-issue di naira notes every five to eight years.

YOU GO LIKE READ: Avoid These Top 10 visa Rejection Reasons

di last time wey di bank redesign di naira na for 2014 when dem change di design of only di 100 naira note to commemorate Nigeria centenary.

According to am, e no good as dem never redesign di naira for di past 19 years because of lack of political will from previous administrations.

This tori ey inside DailyPost…READ MORE

For more news: Na Snapchat filter dem take redesign di new naira note – Sowore blast CBN

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *