fbpx
May 6, 2024

Dunsin Oyekan challenge Christians – “You wan hear God and you dey listen to Asake abi?”

dunsin-oyekan-challenge-christians-wey-dey-liten-to-secular-and-gospel-song-

Dunsin Oyekan challenge Christians wey dey listen to gospel and secular songs.

Hin tok say di confidence of di pipo wey dey that category dey make am wonder as dem dey even dey call dia sef unapologetically children of God

Dunsin Oyekan challenge Christians with better question. Hin yarn say how dem wan take hear God when dem dey listen to Asake.

One of di example wey hin give na pipo wey go listen to Nathaniel Bassey song after dem don listen to Asake.

Dunsin Oyekan comment about pipo wey dey listen to secular and gospel artists don dey trend for social media.

 “Those kain Pipo dey live inside confused state because dem no go fit hear from God”;  Na wetin Dunsin Oyekan tok be that for one of hin ministration.

Hin tok about pipo wey tag some of dem gospel artists for dia Spotify, Apple review for di year. Some show secular musicians and Nathaniel bassey.

Na wetin make am ask say wetin Nathaniel Bassey dey do for there?

“You dey listen to person wey dey tell you about di world, and another one dey tell you e dey go with God, which one you wan pick”.

You fit go read di full tori…READ MORE