fbpx
May 5, 2024

Kamal Iliyasu don kpai inside fatal car acident

Nigeria-Skitmaker-kamal-iliyasu-don-kpai

Kamal Iliyasu don kpai for inside fatal car accident, di name with pipo take know am na popularly known as Kamal Aboki. Hin be one of  Nigerian skitmaker.

Report tok say di Hausa indigenous comedian bin dey go Kano from Borno State on Monday, January 17, 2023.

For interview with BBC, hin elder brother, Usman, confam say Kamal Iliyasu don kpai and hin open up say dia mama bin get bad feeling about hin movement. Her mind bin tell her say bad thing go happen to Kamal.

Na later person rush kon tell am say hin brother wey go Maiduguri for album launch don kpai.

FOR MORE NEWS: Mike Afolarin interview don expose how school drive am into acting

Di person tell am say hin kpai for inside terrible car accident as hin dey Kano.

Usman yarn say as hin brother kpai, all di family members no get dia sef at all.  Hin say dem go miss am well well because hin be one of di nicest people for this world.

Usman tok say:

On Monday, hin mama tell am make hin call Kamal around 5 pm, and when Kamal answer, hiin tok say hin don enter car dey go Kano. Na so hin mama start to dey feeli somehow.

Later, kon call am ask am weda e get person wey dey travel from Maiduguri to Kan. As hin tell di person yes.Di caller kon break di news of wetin happened. Dem tell am say Kamal Iliyasu don kpai for inside fatal car acident.

You fit go read di full tori…READ MORE