fbpx
May 5, 2024

Economic expert support FG on petrol subsidy removal

economic-expert-support-subsidy-removal

One economic expert, Dr. Tunji Ogunyemi of di Obafemi Awolowo University (OAU), Ile-Ife, Osun State support di plan on total removal of fuel subsidy by di Federal Government.

During interview with Rave FM, Osogbo on Friday, Ogunyemi, yarn say di removal of fuel subsidy dey inevitable.

He yarn say Nigeria go bankrupt if e continue with di subsidy regime on Premium Motor Spirit (PMS).

Di economic expert, wey admit say to remove di PMS subsidy go create more hardship on di citizens yarn say, “no development for any part of di world don ever dey achieved and made possible without pain.

FOR MORE NEWS: I smart pass pipo wey go school – Portable dey boast

According to wetin di economic expert wey support di subsidy removal, hin tok, say di grave truth of dis matter be say we no fit sustain dis subsidy again.

However, di only thing wey di government need na to establish a basis for social trust.

Also, dis na trust wey di  pipo fit see and relate with.

In addition, he suggest say make di Federal Government remove di subsidy and plan am to a specific area of development.

Ogunyemi yarn say di high debt profile of di Kontri calls for immediate removal of petrol subsidy.

You fit go read di tori…READ MORE