fbpx
May 1, 2024

200,000 out-of-school children back to school for Sokoto

200,000-out-of-school-children-

Under di non-formal learning system, Sokoto State Government don send over 200,000 out-of-school children back to school. All this one happen within one year.

Altini Kajiji, di state chairman of di Universal Basic Education Board na hin drop this update as hin dey follow newsmen tok for hin office.

Kajiji yarn say as hin enter office as di chairman of di board for February 2022, di board wey dey under hin watch don provide sporting materials wey worth over N30 million.

Hin still explain say apart from di establishment of 41,000 non-former learning centres under the project, over 1,700 volunteer graduates na hin dem employ for di process.

Hin tok say dem don construct equip 76 post literacy skill acquisition centres for di state, all this one join di construction and renovation of schools.

FOR MORE NEWS: Pastor fake kidnap for Jos, collect N600,000

Kajiji still explain say di board constructed boreholes, shades and toilet facilities for some centres weey dey di state. Dem don provide about 39,941 double seater furniture for schools for di state.

As di chairman dey give hin briefing, hin confirm say hin administration dey work very hard so that teachers welfare, especially di ones wey dey primary schools go dey settled.

He yarn say as dem improve di welfare and as dem implement some important things, e go ginger more teachers especially di ones wey dey rural area across di state make dem come teach for di school.

 out-of-school-children-for-Sokoto

As dem make sure say all this thing dey in place, di education boss dey encourage teachers for di state, especially those one under di board, say make dem pay back with better service. Di 200,000 out-of-school children wey Sokoto government don send back to school na better initiative.

You go like go read di full tori…READ MORE