fbpx
May 9, 2024

BREAKING: Bandits kidnap Federal University Gusau students

gusau-students-don-enter-kidnappers-hand

Unknown number of students for di Federal University of Gusau don enter di hand of kidnappers dis morning, Friday, 22nd September 2023.

Also, one resident of Sabon-Gida, wey dey identified as Nazeer Sabon-Gida, tell newsmen say di gunmen raid di community around 3 a.m. and na so dem start to dey shoot anyhow.

However, di resident tok say as di matter be, dem neva confirm di number of students wey dey kidnapped because di bandits enter three hostels kidnap all di students there. E dey hard for dem to know dia umbers now.

Another eyewitness tell news media say di bandits bin dey engaged with troops of di Nigerian Army for serious gun battle, but dat one no stop di bandits from escaping with di kidnapped victims.

 

FOR MORE NEWS: ‘Bullying na hin make me anti-social” – Kizz Daniel

 

Di person tok say na serious gun fight with di army troops but di way these bandits operate, dem go divide themselves into two, one group go move with di kidnapped victims while di other go stay behind to protect di first group.

Also, hin tok say di first group comot with di students while di second group engage di army in gun duel.”

Some university students bin protest about di kidnappings wey  happen for Sabon-Gida and Damba three months ago.

More details to come…

Gusau students don enter kidnappers hand, You fit go read di tori…READ MORE