fbpx
April 28, 2024

Electricity Spark Kill Family Of 4 for Zaria

electricity-spark-kill-family-of-4-for-zariaj

On Friday, for Kofar Gayan Low Cost, Zaria, na four family members kpai. Na Electricity Spark Kill Family Of 4 for Zaria

Mohammed Umar, di head of Fire Service unit for Kofar Doka, Zaria na hin confam di incident. Hin tok say di fire outbreak happen for di early hours of Friday.

Di time wey hin confam di incident, hin bin neva know wetin cause di fire incident, but dem suspect ay na electric spark cause am.

FOR MORE NEWS: Dem pursue Arise TV cameraman comot for Tinubu event

One eyewitness and neighbour to di family of di deceased, Safiyanu Aliyu, yarn say di incident claim di lives of Alaramma Mohammed Sani, wey be imam, hin wife, Raulatu Sani and two of dia children, Hashim Sani age 8 and Fatima Sani age 1 and half years.

One of di neighbour, yarn say na high voltage of di electricity supply na hin cause di unfortunate incident.

Another vigilante group yarn say dem bin dey on patrol wen dem see fire.

As di Electricity Spark Kill Family Of 4 for Zaria, some other pipo tok say na di sudden power supply cause am. Di voltage bin dey too high.

You go like read di full tori…READ MORE