fbpx
May 3, 2024

Hin deserve hin ordeal – Traders dey celebrate Emefiele suspension

traders-celebrate-emefiele-suspension

Plenty traders for Umuahia, Abia State capital don express happiness, and dem dey celebrate over di suspension of di Governor of Central Bank, Mr Godwin Emefiele.

Di traders wey tok on di development on Saturday evening yarn say Emefiele no deserve dia sympathy for hin present predicament.

Also, as di traders dey celebrate Emefiele suspension, one trader for Isi Gate and Orie Ugba markets for Umuahia accuse di Emefiele-led CBN say hin spoil dia businesses for di first quarter of 2023 through poor management of di naira redesign policy.

Apart from dat matter, di traders accuse di suspended CBN Governor say hin prove ‘stubborn’ as hin no obeying di directives of di Supreme Court concerning di naira issue.

 

FOR MORE NEWS: SERAP don sue Tinubu over ‘missing $2.1bn, N3.1trn subsidy payments’

 

One butcher, Mr Joel Onyekachi yarn say hin neva recover from di losses wey hin business experience because of di cashless challenges of February and March wey for most situations, make am throway  di meat wey hin buy.

Also, fruit dealer, Mrs Kate Amadi yarn say di news about di suspension and detention of Emefiele na one of her happiest moments for life as according to her, “that man and hin policy show her pepper. So why I no go happy now?”

She advise Nigerian leaders make dem dey mindful of actions wey dem dey take and wey fit affect di general well-being of di citizen.

You fit go read di tori…READ MORE