fbpx
May 9, 2024

Transfer: Two reasons Salah no fit go Saudi Arabia – Carragher

salah-no-fit-go-saudi-arabia

Former Liverpool defender, Jamie Carragher yarn say hin no fit dey watch make Mohamed Salah comot for di Premier League for di final week of di window despite late interest from Al Ittihad. Carragher don give two reasons why Salah no fit go Saudi Arabia.

Salah na di subject of interest from di Saudi Pro League. Dis na as Carragher bin tok before say only offer above £150m na hin go fit tempt Liverpool.

But di Sky Sports pundit feel say di short time to reinvest in di squad go mean say di move away from Anfield no dey sure.

 

FOR MORE NEWS: Transfer: Arsenal confirm deal for Norton-Cuffy ahead of Fulham clash

 

I no think say Mo Salah go comot. One, because e dey too late for di window.Also, hin no necessarily think say Mo Salah sef go wan comot. Na wetin Carragher tok be dat.

Also, hin feel say Salah go dey like Ronaldo, and hin fit see di guy dey play until hin late 30s.

Carragher yarn say Salah fit get another three or four years [at the highest level]. Hin get two years left for hin Liverpool contract, but hin no know weda di guy go stay beyond dat time. Na di reasons be dat why Carragher  yarn say Salah no fit go Saudi Arabia.

You fit go read di tori…READ MORE