fbpx
April 25, 2024

Falana talk say Lagos parking levy dey illegal, Make una comot am

0
Femi Falana\talk\say\the\parking\levy\dey\illegal\

Human right lawyer, Femi Falana SAN, don ask Lagos State Government say why dem for dey do parking levy for the state.

On Sunday, Falana don talk say the parking levy thing wey dem dey do no dey right at all. He talk say e dey illegal and Lagos state government need to comot that kain rule, make dem no waste time at all.

You fit also enjoy this Article: Importance of Financial Management

The lagos state government bin don carry letter go give one food and snacks company like that, say make them pay N290,000 for the space wey dem use pack car outside the compound of the company.

According to the letter,dem tell the food company make them pay N80,000 every year for the three parking lots, a non-refundable administrative processing fee of N50,000.

But that decision kon make the everybody dey think say weda na way wey dem wan take dey collect people money dey use for their own project. Falana don talk say the parking levy wey dem dey do no dey legal at all, make dem comot am.

You fit read more of this tori, CLICK HERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *