fbpx
April 19, 2024

KSI don knock out im boxing rival Pineda, Swarmz for London

0
KSI\knock\out\boxing\rival

KSI don knock out im boxing rival Pineda, Swarmz for London

Internet celebrity, Olajide Olayinka Williams, wey everybody sabi as KSI, beat im two rivals for the 02 Arena wey dey London, England.

After KSI don beat Luis Alcaraz Pineda finish, he start to do push up and the reason na to yeye the person wey he beat.

The influencer wey turn musician and fighter bin don beat the English rapper, Brandon Scott wey people also know as Swarmz on Saturday.

You fit also enjoy: I tell my mama make she no sell friut again after I get deal with Mavin. – Crayon

KSI cover up for the times wey e don lose, after three-years wey he no dey as he beat TKO (technical knockout) opponents for one night.

Marca report first first say, KSI beat rapper Swarmz for two rounds. After that on, he later beat the Mexican professional boxer Luis Alcaraz Pineda for three.

The 29-year-old KSI drop the 23-year-old Pineda for each round while the journeyman just dey complain of punch for the back of Im head.

Dem try to tell us how this guy come back with power wey he take fight two opponent, kon win them for one night.

You fit read more of this tori when you CLICK HERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *