fbpx
May 18, 2024

BREAKING: Missing Christian Atsu don kpai inside Turkey earthquake

Christian Atsu Turkey earthquake

Christian Atsu Turkish agent, Murat Uzun Mehmet, don confirm say di 31-year-old footballer don kpai inside Turkey earthquake.

Dem see di former Newcastle and Chelsea player Christian Atsu dead underneath di rubble of di 7.8 magnitude earthquake wey hit Turkey and Syria on Monday, February 6.

Atsu, wey bin dey contracted to Turkish side Hatayspor bin score better 97th-minute free kick for dia 1-0 victory against Kasimpasa for di Turkish Super a day before di earthquake strike.

Inside di heartbreaking development, e dey report say Atsu suppose comot from di country but hin change hin mind after hin score di winning goal.

FOR MORE NEWS: Earthquake kill 640 people for Turkey and Syria

He dey survived by hin wife and two children.

According to report, over 45,000 persons dey confirmed dead for inside di tragic earthquake and plenty piooi still dey missing.

On February 7, news make rounds earlier say Christian Atsu bin dey rescued after dem hear hin voice under di rubble of hin Turkey house.

Also, di spokesman of hin club, Hayatspork, follow claim say dem bin carry di winger go hospital with undisclosed injuries after  ‘miracle rescue’.

However, inside di statement wey hin agent post online, Nana Sechere, on Feb 8, he yarn say Atsu still dey missing and dem neva know where hin dey

You fit go read di full tori…READ MORE