fbpx
May 18, 2024

Fans gift Liquorose N6m, delivery bike, other items on birthday

fans-gift-liquorose-on-birthday

Big Brother Naija, BBNaija Season 6 runner-up, Roseline Afije, wey dey known as Liquorose, don collect gift worth millions of naira from her fans.

Di TV reality star, Liquorose turn 28 on Friday, March 31, 2023, and her fans surprised her with mouthwatering gift.

Inside video wey dey make rounds on social media, di former Big Brother Naija housemate dey shed tears of joy as fans present her 6 million naira, a delivery bike, and other items.

FOR MORE NEWS: Datti: NBC slam N5m penalty on Channels Television hours after Tinubu petition

Also, di fans announce outreach to di less-privileged schoolchildren in commemoration of her birthday.

Remember say Liquorose recently make tongues dey wag online with her oppressive birthday outfit. While some praise her sense of fashion, others dey vex say e no dey decent.

You fit go read di tori…READ MORE