fbpx
April 29, 2024

Fans No Fit Believe Dia Eyes As Dem Spot Tiwa Savage For Local Market

Tiwa-Savage-In-Local-Market

Top Nigerian singer, Tiwa Savage don spark reactions online after dem spot her as she dey shop for di local market for Ghana. Di award-winning songstress, for di past few days don dey enjoy her life for di West African nation as she go on exploration of di countryside.

Tiwa Savage go Ghana with her pikin, Jamil, Davido baby mama, Sophia Momodu and her daughter, Imade Adeleke as part of an initiative wey dey termed ‘Beyond the Return’.

Di songwriter decide to visit Nima market after she entertain fans for di  just concluded Afrochella.

FOR MOR NEWS: Yemi Alade don drag followers wey wan tell her wetin she go do

She wear casual fluffy white top and jeans as she stroll through one section of di market wy dey known for selling herbal medicine.

E dey gathered say after she get some items for di market, Tiwa savage and her family go on movie date for di plush apartment wey she lodge.

You fit go read di full tori…READ MORE