fbpx
May 4, 2024

Transfer: Ferdinand advise Manchester United to make dem pay Osimhen asking price

ferdinand-advise-former-club

Manchester United legend, Rio Ferdinand don advise hin former club say make dem bring Victor Osimhen to Old Trafford dis summer.

Di Red Devils dey inside market dey look for new striker and dem don dey linked with Osimhen, Harry Kane and Rasmus Hojlund.

A move for Kane be like something wey dey impossible at di moment with Tottenham Hotspur Chairman, Daniel Levy sef no dey willing to sell di England international to United.

 

FOR MORE NEWS: Tinubu’s victory: Peter Obi dey ask for non-existent documents against president – INEC

 

Atalanta striker, Hojlund be like something wey hin go fit get but dem neva prove am for di highest level.

Ferdinand dey feel say Osimhen go be di best forward for di club and hin advise United say make dem pay hin asking price.

“Do it. Look at the market. Who else is there? There’s no one ready-made,” Na United in Focus wetin Ferdinand  tok.

Osimhen score  31 goals all competitions for Serie A champions Napoli last season.

You fit go read di tori as Ferdinand advise hin former club…READ MORE