fbpx
May 8, 2024

Fernandes dey avoid Ronaldo, only Pepe dey get along with am for Portugal squad – Marius Niculae

Bruno-Fernandes-Ronaldo

Cristiano Ronaldo former Sporting teammate, Marius Niculae, claim say Bruno Fernandes dey avoid di Portugal captain.

Niculae follow insist say na only Pepe na hin dey rapport with Ronaldo for di Portugal squad. Hin add say di team no accept am again.

Di former Romanian international play nine matches with Ronaldo for di time wey dem dey together for Sporting CP for di  2022-2003 season.

FOR MORE NEWS: Joshua don fail – Fury

According to am, Ronaldo bin no dey social and hin dey always dey live for hin own world.

As hin dey follow Digi Sport Special talk, Niculae yarn (via MARCA) say [Ronaldo] bin no be sociable person. Dem dey always try make am come table to chop with dem , but hin dey always dey hin own world. Hin dey go gym alone. Sometimes, after training, all of dem go waka go chop food but Ronaldo no go follow.

You go like read di full tori…READ MORE