fbpx
April 23, 2024

First Lady, “Aisha Buhari don fat because of naija money wey she dey chop”. Officer don arrest final year student because of this talk.

0
FUD-officers-arrest-student-

New report claim say di State Security Service  don arrest student of di Federal University Dutse over hin five months old tweet wey dem talk say e dey  defamatory against Nigeria First Lady Aisha Buhari.

Peoples Gazette report say one Aminu Adamu Muhammed, final year student of Environmental Management And Toxicology at FUD, Jigawa State, bin   post for Twitter sometimes around June say Mrs Buhari don suddenly add weight after she follow chop Naija money wey never dey enough for di country.

YOU GO LIKE READ: 9 Tips to Stay Productive at All Times

According to di report, Mr Muhammed friends wey don go social media, reveal say hin make the post because hin bin dey frustrated that time about di prolonged strike by universities across di country. Di ASUU strike wey bin start for February 14, 2022, end just last month, October 14th.

According to one family source, officers pick di 23-year-old student on November 8 for di campus ground of Federal University Dutse, Jigawa. Dem report say hin collect serious beating from di officers before dem arrest am around 12:00 noon.

You fit go read more of this tori…CLICK HERE

For more news: We no fit sit down look make persin like Ngige dey ridicule Us –ASUU chairmo

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *