fbpx
April 25, 2024

One don kpai as 3 don dey for police custody for Awka cultist clash

0

At least one persin don kpai among two rival group, according to tori way we bin hear for Awka cult shooting on Saturday morning.

Earlier dis morning according to report way we bin hear say some cultist group bin fight each other  for Ziks Avenue for Awka.

U FIT ALSO READ Police don arrest five guys wen dey impersonate EFCC operatives to defraud pipol for Delta State

According to tori, other group bin carry one member of di other cultist groups comot, way dem con later find hin dead bodi for different location.

Report tok say police pipol don arrest three persin way bin dey in connection and know about di clash of di cultists.

Di tok tok persin for di State command, DSP Toochukwu Ikenga don confirm di incident to tori pipol. hin tok say di operation still dey go on by dat time wen dey give di report.

Ikenga tok say “ di rival group bin carry one persin away and wen dey go later see dat persin way dem carry comot dey don kill am na di dead bodi dem see for ground along Abba/Ifitedunu Road for Anambra state.

Hin con tok say dey don alreadi arrest three suspects and dem dey for dia custody like dis, and operation still dey go on…

To read di full tori CLICKHERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *