fbpx
April 26, 2024

We no fit sit down look make persin like Ngige dey ridicule Us –ASUU chairmo

0

Di Academic Staff Union of Universities, Federal University of Technology Minna, Chapter, don call on di Federal Government not to treat dia members like casual workers.

Di Chairmo of di union, Gbolahan Bolarin, yarn dis one during one protest for Minna on Friday, over di payment of half salaries to university lecturers.

U FIT ALSO READ Goodluck Jonathan – How I take end ASUU strike for one night

Bolarin tok say how FG con look down on dem sote FG con pay dem wages per say na numbers of days way dem show for work. Instead of FG to pay dem full salaries for di month of October

FUT Minna chapter of ASUU don come out say lai lai dem no go gree say make FG be little Nigerian scholars to dat of casual workers by di minister of labour and employment Chris Ngige.

Hin tok say dem no go open dia eyes down make minister of Labour amd employment destroy our public universities under any circumstance.

Bolarin tok say if Ngige no know make he open hin hear down make him tell am wetin hin no know say, Nigerian lecturers dey among di best lectures in di world.

Hin still tok say, di half salary wen FG pay to ASUU lectures na big insult e bi to dem as an academic staff, and Nigeria as a countri..

Lecturers for Federal University, Lafia, Nasarawa State, don call for di immediate sack of di Minister of Labour and Employment, Dr Chris Ngige.

During one protest demonstration, di Chairmo of ASUU  for di institution, Adam Abdullahi, tok say, “ di reason for dis protest na to tell FG to sack di Minister of Labour and Employment,

Di protest na to also tell FG to pay us dem di remaining half salary.

To read di full tori CLICKHERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *