fbpx
April 23, 2024

Security threat: Make una shine eyes. Sanwo-Olu wife advice market leaders

0
Sanwo\olu

WIFE of the Lagos State Governor, Dr. Ibijoke Sanwo-Olu, don advice market union leaders and stakeholders for Lagos make dem shine dia eyes well, make dem dey at alert so that dem no go enter yawa as everywhere no safe again.

Mrs. Sanwo-Olu, tok this one for di seminar wey dem organize for weekend by the Committee of Wives of Lagos State Officials, COWLSO.

The Ministry of Local Government and Community Affairs do this one to sensitize women wey dey sell things on “Market Sanitation,  Security and Safety for Market Leaders,” for Surulere division of Lagos State.

You fit like to read: Terrorism: Nigeria dey No 2 upon di N11tn security budget.

She advise market people make dem join di system of intelligence gather dey reveal information of security threats to the proper channels.

According to Mrs Sanwo-Olu, who be the Chairperson of COWLSO, “We know put di security and safety of our markets as part of the topics for this seminar for reason wey every body know.

Security na everybody business, and as market men and women and community leaders, we must dey conscious of the need to make our security number one.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *