fbpx
May 6, 2024

Police officers for Emefiele house don make pipo dey wonder

Police-officers-for-Emefiele-house-dey-watch-am-

Police officers for Emefiele house don cause serious tok and debate as dem see di team of policemen for di Federal Capital Territory home of di Central Bank of Nigeria Governor, Godwin Emefiele.

Di numbers of di armed Police officers for Emefiele house pass 10, according to report on Tuesday.

One beta Nigeria Police Force yarn say di police officers for Emefiele house dey there because di Federal High Court for Abuja dey expect hin appearance on Wednesday (today) over di $53m judgment debt wey come out from di Paris Club refund.

Di source yarn say di police officers just dey watch am, dem no arrest am. Dem no want make hin run go anywhere again as hin take do before.

FOR MORE NEWS: Governors of di 36 states plan to meet di CBN, Godwin Emefiele

DSS no fit arrest CBN governor Emefiele again as hin don resume duty.

Di last time wey hin hear say dem wan arrest am, hin go di United Kingdom and di United States spend week for there. But now, hin don resume duty for di central bank headquarters for Abuja.

For inside statement, CBN Director of Corporate Communications, Mr Osita Nwanisobi, of apex bankyarn say di governor resume work upon how pipo bin dey worry over hin  absence since last month.

Another tori be say di DSS on Monday deny say dem raid CBN head office for Abuja.

Di High Court of di Federal Capital Territory, on December 29, don give order to DSS and di Inspector General of Police ay make dem no arrest or detain Emefiele, over di  allegations of terrorism and sundry offences against am.

Na  why di court order for di hearingof di matter from di respondents and di applicant.

You fit go read di full tori…READ MORE