fbpx
April 24, 2024

Gunmen enter kill two pipol, kidnapped 13 pipol inside Sokoto.

0

Two pipol don change address go heaven and 13 pipol is nowhere to be found inside Mamman Suka community of Gwadabawa local council of Sokoto State.

Gunmen don dey enter dis community now no be today and wen dey entrt dem go kill,kidnap collect money and properties wen the pipol get.

U FIT ALSO READ US Security Alert: DSS say make everybody calm down shine eyes

According to tori, dis gunmen attacking matter don make many pipol run comot for di community and even pipol wen still remain too dey fear and preparing to run too becos of di killy killy wen dey happun for di community.

Di council chairmo, Alhaji Aminu Aya, confirmed di attack, con yarn tori pipol say di gunmen enter di community and operate freely for hours without resistance

“di bandits kidnapped 11 girls and two boys. Dey also carry dier goat,cow,fowl and other valuables including phones and money. Dis kind thing happun for di community without any intervention nor support from di security pipol for inside di state.

“Alhaji Aminu Aya con tok say na beg him dey beg our security agencies make dem please rescue those pipol wen dem kidnapped from those gunmen hand to avoid stories and touch.

To read di full tori CLICKHERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *