fbpx
May 18, 2024

“I go marry second wife if my wife agree” – Singer, Harrysong

harrysong-wan-marry-second-wife

Popular Nigerian singer, Harrison Okori, wey dey professionally known as Harrysong, don tok say hin wan marry second wife, but na  if hin wife agree.

Remember say di “Reggae Blues” crooner, as hin dey celebrate hin wife Alexer Perez Gopa birthday via hin Instagram page last Wednesday, hin jokingly tok say hin dey plan to take second wife.

Inside hin birthday message to hin wife, he acknowledge her as good and sweet woman, but humorously add say e no go stop am from marrying second wife.

 

FOR MORE NEWS: Nigerians dey celebrate Eid-el-Kabir in frustration – PDP lament over cost of living

 

“Today is my wife’s birthday 😀😀 God woman. Sweet woman, my love. But I will still marry a second wife, sha 😀😀😀😀”, na wetin hin write be dat.

To shed more light on di statement for inside recent interview with Hip TV, Harrysong explain say hin wife go need to agree before hin go fit marry second wife.

Also, hin express hin love and respect for hin wife and hin tok say hin no go take any action without seeking her permission. In addition, he yarn say hin desire to marry second spouse come from hin love for a large family. And na why hin go like marry another wife. But hin wife go need agree first.

You fit go read di tori see di gist as Harrysong tok say hin wan marry second wife …READ MORE