fbpx
March 29, 2024

Hoodlums kill Oba and two of hin workers,for Imo — Police

0

Di Owerri Police Command, yesterday, don confirm di dealth of traditional ruler of Obudi Agwa, for Oguta Local Government Area of Imo state, Eze Ignatius Asor, and two of hin workers

According to tori we hear say na some hoodlums shuut am and dey bin suspect di members of di Eastern Security Network, ESN.

U FIT ALSO READ Nurse arrested for touch lighting one 14yr-old girl

Di state Police Public Relations Officer, PPRO, Mike Abattam, na him confirm di incident to tori piolpol for Owerri imo state.

Hin tell tori pipol say dose guys drive enter di oba palace and dey pretend to di oba like say dey need help

As di oba welcome dem into hin palace di next thing bi say dey comot gun con shuut di oba and hin two workers

Abattam yarn tori pipol say according to investigation wen dem do dem see say those hoodlums carty four vehicles and two motorcycles enter palace dat day.

On dia way going,dem still attack di office of di Agwa vigilante group,dem shuut one person again con still carry three motorcycles run away

To read di full tori CLICKHERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *