fbpx
April 28, 2024

Wizkid don show hin second pikin face with Jada P

wizkid-don-show-hin-second-pikin-face-with-jada-p

Wizkid don show hin second pikin face with Jada P, hin third baby mama and manager, Jada Pollock.  Ayodeji Balogun, Aka Wizkid na papa of four. Pipo for don dey wait for di day wey hin go show hin pikin face.

Wizkin no disappoint fans and followers wey don dey wait for that moment. Na for hin official Instagram page on Friday night, January 13 hin drop di update. For di post, hin share photos of hin two children with Jada.

As di Nigerian singer  and share di post of di beautiful photos  for hin Instagram page, hin caption am with love emoji. That one na to show say hin love them no be small.

FOR MORE NEWS: Dem pursue Arise TV cameraman comot for Tinubu event

E neva too tey wey di video of Wizkid and hin pikin go viral. Hin bin dey teach di pikin hoe to chop food.

Wizkid caption di moment adorable father-son moment. For inside di video, di superstar singer bin dey chop di food wey resemble  fufu, while hin pikin Zion wey sit down near am kon dey copy am.

That video bin bring different reactions for social media. But di latest update no be say Wizkid don show hin second pikin face with Jada P.

You go like read di full tori…READ MORE