fbpx
April 19, 2024

I no offer Kwankwaso N40bn to step down for me – Peter Obi

0

Di presidential candidate of di Labour Party, LP, Mr. Peter Obi, don come out deny di fact say hin bin offer N40 billion to di flagbearer of the New Nigeria Peoples Party, NNPP, Alhaji Rabiu Kwankwaso, to step down for him.

Obi tok say na big lie oo, how me obinna pikin wen mama born finish check di whole word she no see name give me sote she con name me ” My children ” go con stood so low con dey beg persin to step down for ram with a sum of N40billion hin tok say no bi him.
Obi yarn dis one on Monday for one interactive section with di Nigerian Guild of Editors, NGE, for Lagos.

U FIT ALDO AND I sabi di root to Nigeria problem — Peter Obi 

Obi yarn tori pipol say if hin look at all di matter wen hin don discuss with Kwankwaso, hin no think say hin promise am any money to step down for ram.

Di former Anambra governor tell tori pipol say nobody dey fund hin campaign. Up till now nobody fit come out say na hin dey fund Peter Obi. Na only me dey fund myself.

Wetin pipol must consider bifore dey cast dia vote bi say make dem no allow “ Nepotism” becos e dey more corrupt dan bribery. So make dem no allow those politicians deceive dem.

Perer obi tok say “ make pipol no vote for ram becose say hin na Igbo or becose na my turn.

Nigerians must vote for person wen get better character which dem fit trust,
Di job of a leader na to provide solutions to problems not to give excuses. If me Obi enter as Nigerian president, I no go give excuses but results.

Therefore, I want make Nigerians hold me responsible if things no go on well well under my leadership” na wetin obi tok bi dat.

To read di full tori CLICKHERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *