fbpx
April 24, 2024

Ruling dis countri seh na your birthright — Tony Umez blast old politicians

0

Popular Nija Nollywood actor, Tony Umez don officially endorsed di presidential candidate of di Labour Party, Peter Obi, for di 2023 election.

Tony tok say di reason why hin endorse, di Labour Party candidate bi say na only peter obi wen hin don see wen tok di right thing and don do di right things both now and in di past.

U FIT ALSO READ APC no bi God,Nigerians shine your eye – Peter Okoye

Hin yarn dis one for one interview with BBC, hin tok say make dem wake am for sleep still ask am di same question say who hin go vote for him go still let pipol know say Obi na di way for Nigerians.

Tony tok say “Some Nigerians politicians think say na dia birthright to rule Nigeria. Hin no know where dem get dat yeye sense from.

Hin tok say Nigeria na countri wen God bless with great pipol and beta natural resources full everywhere, but di only problem wen we get bi say we no get better leaders and dis thing dey make Nigerian youth dey vex.

All those pipol wen don come out say dem wan rule us don forget say dem dey part of our problem for dis countri and if you dey part of problem you no fit bi part of di solution to di problems.

Tony Umez tok say di same set of pipol wen rule di countri wen hin still dey for small pikin,na dem still dey come out again say dem wan rule again hin say whyyyy,how di countri wan take grow.

Hin tok say u fit don do some things bifore wen you dey power. But if wetin you do no get positive impact on di citizen of di countri, dat one mean say na nonsense you do.

if you ask persin wetin dem dey do for a living, dem go tok say dem bi politician.seh dat one na job? ” It’s a call to service.” Na wetin oyinbo pipol dey call am bi dat.

But for Nigerian politicians, dat Service na place where dem dey earn dia living from. Our leader go just dey thief money without di fear of God.

Some celebrities, including veteran Nollywood actors Kanayo O. Kanayo, Keneth Okonkwo, Okey Bakassi, Kate Henshaw, Charlyboy, Daddy Freeze, comedia Macaroni, Psquare, Phyno, Flavour, Ruggedman, among others don declared dia support for di Labour Party candidate, Peter Obi.

To read di full tori CLICKHERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *