fbpx
May 4, 2024

Ikpeazu don cancel excess fees for ABSU

ikpeazu-cancel-excess-fees

Di management of Abia State University, Uturu, ABSU, don go back to di old school fees wey students of di institution dey pay, dis na as Ikpeazu cancel excess fees for ABSU.

Remember say di University, according to a pressure group, Mezie Abia, bin increase school fees from about N120,000 to N500,000.

Di group claim say di increase na design by Prof Maxwell Onyemachi-led institution to deny poor students dia rights to education.

But Governor Okezie Ikpeazu for hin intervention, don order di immediate cancellation of di excess school fees regime wey di school management introduce.

 

FOR MORE NEWS: Twitter don suspend Hundeyin account over post on Tinubu citizenship

 

Ikpeazu, wey give di order through a statement by hin Chief Press Secretary, Onyebuchi Ememanka, yarn say geometric increase in fees no dey acceptable to hin administration. Also, hin add say di children of di poor must get equal academic opportunities to access tertiary education.

Also, complying with di Ikpeazu directive, ABSU issue statement wey tell students make dem continue to pay di old school fees until further notice.

Di statement by Acho Elendu, di Registrar, read in part, “fees paid students of Abia State University remain the same until otherwise stated. Please be properly guided.”

You fit go read di tori as Ikpeazu cancel excess fees for ABSU…READ MORE