fbpx
May 18, 2024

“Some men prefer monkeys wey give dem peace of mind” – Jane Mena don drop advise for ladies

jane-mena-drop-advise-for-women

Nigerian dancer and influencer, Jane Mena drop advice for women wey believe say dia beauty na  hin make dem di ideal partner for any man.

She yarn say beauty alone no dey enough, as some men prioritize finding partner wey go bring dem inner peace, even if  dem no dey conventionally attractive.

Jane Mena share her advice on top her Instagram page, and she highlight di fact say just because woman dey  beautiful no necessarily mean say every man go view her as di ideal partner.

 

FOR MORE NEWS: “I make over N25million every year as bus driver in UK” – Man reveal

 

She still explain say men dey find partners wey go provide dem with a sense of calm and tranquility, regardless of external appearances.

In her words;
“That you’re beautiful doesn’t mean that you’re every man’s dream, some men prefer we the monkey that gives them peace of mind. Know this and rest.”

You fit go read di tori of Jane Mena advice for women…READ MORE